AfricaGeneral News

Kenneth Kaunda dies: Zambia first president, KK don die – Prez Edgar Lungu confirm

Kenneth David Buchizya Kaunda, di founding father of Zambia don die, BBC fit confirm.

Di 97-year-old bin serve as Zambia first president from 1964 to 1991.

Kenneth Kaunda death occur on Thursday, 17 June, 2021.

“I leant of your passing dis afternoon with great sadness.”

Na wetin Zambia president Edgar Lungu write as e confirm Kaunda death.

Di Zambian elder statesman bin dey admitted to hospital in Lusaka earlier dis week.

Kaunda bin suffer from pneumonia last Tuesday wen dem admit am for hospital, wit one minor chest infection.

“You don go at a time we least expect but we dey comforted say you dey now with Our Father, God Almighty inside heaven.”

WIA DIS FOTO COME FROM,DR. EDGAR CHAGWA LUNGU/FACEBOOK

“On behalf of di entire nation and on my own behalf I pray say di entire Kaunda family dey comforted as we mourn our First President and true African icon.

“May di soul of Dr Kenneth David Kaunda Rest In Eternal Peace.” Presido Lungu add.

Di former president of Zambia na one of the founding leaders of post-colonial Africa.

Di leader of Kenneth Kaunda party Hakainde Hichilema also confam di death

Hichilema wey be presidential candidate for Zambia August 12, 2021 elections say:

‘Dr Kenneth David Buchizya Kaunda pass away peacefully in Lusaka today, after a short illness.’

Hakainde Hichilema na di President of di United Party for National Development, wey be di kontri main opposition political party.

Tributes don dey pour for Kenneth Kaunda death from within and outside Zambia.

WIA DIS FOTO COME FROM,GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto,

Kenneth Kaunda

How Kenneth Kaunda become Zambia founding father

Kenneth Kaunda na Zambia first president and giant for di fight against colonialism for dat kontri.

Im become Zambia founding president at di age of 40 for 1964 afta colonial rule.

Kenneth Kaunda lead Zambia from independence from Britain in 1964 until dem defeat am for one multi-party elections in 1991.

Kaunda, di youngest of eight children, na school teacher before im join di independence struggle.

Dis na wen im became known for im guitar playing, composing liberation songs.

Dat time e also travel around di kontri to drum up support for di campaign against colonial rule.

Popularly known as KK, during im presidency he become a tuff critic of apartheid South Africa.

Kenneth David Buchizya Kaunda bin also frown for white-minority rule for di then Rhodesia, now Zimbabwe.

And he allow groups wey dey fight dis goment, like di African National Congress (ANC), to make Zambia dia base.

To begin wit, he make huge strides towards improving di lot of Zambians.

But Kaunda betray di promise of democracy by introducing a one-party state for 1973.

WIA DIS FOTO COME FROM,GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto,

Kaunda as di President of Northern Rhodesia United National Independence Party, on im way to di 1962 African People’s Congress

Oga Kaunda na di only candidate for elections for 1978, 1983 and 1987 – score more than 80% of di vote each time.

Within im own party, he change di rules to keep getting selected as di only candidate.

Eventually, Zambians feel Oga Kaunda don overstay im time in office and dem vote am out for 1991 after mass protests force am to reintroduce multi-party elections.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Related Articles

Back to top button

Adblocker Detected

Turn Off your Adblocker to continue.